Credits
KOMPOSITION UND LIEDTEXT
Alfred Atungu
Songwriter:in
Lyrics
This is for all those
Who found themselves in situations they'd rather not be in
Maybe by their making, by some wrong decision
Or maybe by chance, circumstances
It's time to break free
Scream will me!
E don do me!
I dey stay with my uncle, my portion dey double
Of the work wey I get to do, see me see trouble
Na me dey eat the smallest ration, dey wash the most plate
Him children nothing dem dey do, people for God sake
Na me dey wake up first, na me dey sleep last
Na me dem dey beat because I no dey fit pass
But how I go pass when I no fit rest
From sunrise to sunset, my life na so-so stress
If I say make I relax small, my uncle go dey hala
The thing dey break my head like say I sleep for banana
The fall when I wan fall even the ground no dey
Because the wife contribute to make me suffer sotey
I look up, I look down, I no dey happy throughout
Mek I run? I think am, hmm-mm, no need to pull out
But if I make mistake na knok I dey receive
So one day my uncle try am himself e no believe
Na so I grab him hand suspend the knok
He call my name, I answer, "Hmm, uncle mek we talk
Your children no dey see the kind wahala I dey see
If I wrong correct me, dem no force you mak you carry me"
I say, I say, I say, I say
Oh, lai-lai
I say, I say, I say, I say
E don do me
E don do me oh
E don do me
E don do me oh lai-lai
Lai-lai
Mr. Agada e too dey beat him wife
Meanwhile, him wife love am like die, wetin be life?
Day in day out her own na to please the man
No matter how hard she try the man no wan understand
Black eye today, black eye another day
Listen to Agada him get something to say
"You no say no be say I like wetin dey happen
And it's not all fights at time me and my wife dey gbadun
Apologies definitely I dey drop
Na my temper dey make me go over the top
Small things dey irritate me, my wife I know she loves me
I love her too, but I can't stop treating her badly"
Foolish man you no go stop before you kill am
We know it's in your nature, but then try to control am
Another day, another blow in the eye
One injury too many make the woman decide
"I can't take it anymore, all these brushes, what for?
Instead of love and respect, I fear my husband the more"
Love become hate, na thin line dey between dem
Enough is enough, she ran away with the children
She say, she say, she say, she say
Oh, lai-lai
She say, she say, she say, she say
E don do me
E don do me oh
E don do me
E don do me oh lai-lai
Lai-lai
The only way to get to chop for my country
Na to dey for government or to know person for government
Poor man like me, how I go fit to make am?
Mek I wait for my turn abi mek I go quickly take am
By force because the way I see am nothing lost
Bros garri still cost na we dey pay the cost
I gats kasala because I don see wahala
While other people dey jellof people see me see wahala
I wan believe say one day these suffering go make sense
But for how long we go dey dey manage, will we ever get there?
To hear the cock crow at dawn after the sunset
The nonsense is still in place because we consent
So I revote, my hunger make me public enemy
I gain popularity but I no be celebrity
For daytime, I no fit drag coat with my master
So for night I enter steal the coat from my master
For daytime, I no fit drag coat with my master
So for night I enter steal the coat from him hanger
I say, I say, I say, I say
Oh, lai-lai
I say, I say, I say, I say
E don do me
E don do me oh
E don do me
E don do me oh lai-lai
Lai-lai
I say, I say, I say, I say oh
I say, I say, I say, I say
E don do me
E don do me oh
E don do me
E don do me oh lai-lai
E don do me oh
Lai-lai
E don do me oh
Lai-lai
E don do me oh
Lai-lai
E don do me oh
Lyrics powered by www.musixmatch.com