Lyrics

What if Heaven and Hell Dey the same street What if Jesus and devil seff dey send streaks What if This life na movie and Zeus dey send script What if What if no God what if no devil What if you wey Jesus call you tell am no level What if we swap our president to the one of 011 What if wetin we need to enter heaven na O level What if na the bad ones Dey go heaven Good ones Dey go hell fire Leave churches what if na only shrine dey get choir Shey peace go Dey if human being part stop to get buyer Abi What if we had to speak in tongue just to quench fire What if we fit take anybody life Who you go kpai What if you woke up as don jazzy Egbon who you go sign What if na animal get city Human Dey stay forest Like imagine one big elephant dey trade forex Like what if your wife carry belle Then she lay four eggs What if human life circle don dey take four years What if What if I fit transfer you my pain Transfer you my feelings What if I fit transfer you my shame What if we belike animal farm for where the gods dey imagine Jesus telling Gabriel kill that one on Thursday What if What if we get past life What if our eye sef get flashlight What if prayer dey answer You no need ask twice What if death get number seff You no need flash twice What if Jesus get reason why him no need house wife What if life no really get end like Ned last wife And What if everytime we pray to God he just half swipe What if What if What if What if What if death Dey knock for door Many men for follow window What if I no get kpa shey this girl for follow me go What if I no like young girls What if I follow only widows What if I give birth to triplet because I follow only migos What if I get supper power Enter bank go burst them From there I enter White House Carry ogun take curse them Then put myself as president if them no vote I force them Shabi when the old men dey rule the suffer dey touch them What if I tell you say I fit perform miracle Shey you go bring all your offering to my pinnacle What if 2025 we still dey waka naked E go mean say our madam eve no see apple What if What if power-bank fit save our lives What if What if na James brown them dey call our wife What if my late father could just text me "I'm alive " What if na Jesus dey tell satan make he stain our white What if When we start to talk them go take our life What if nothing left of us when them take our right What if NEPA just stop to dey take our light What if na only day creator take our night What if Jesus don come back o But baba dey for one side he dey find how To catch us for offside What if everywhere dey peaceful I for just dey chill for opps side Even my ex go dey for my mom side What if What if we no come this planet What if What if we no get internet What if Celestial churches no need garment What if akpi na prove say upcoming no need talent I'm just saying What if What if What if What if
Writer(s): Martins Ehanire Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out