Top Songs By Oga Network
Credits
KOMPOSITION UND LIEDTEXT
Evans Ifeanyibema
Songwriter:in
Lyrics
[Intro]
Rolls Royce no be mate with Akura oh
Oga Network on this
V-E-C
[Verse 1]
I get small bad character, leave am there
Dey try to make amends, oh my dear
No mean say na me be the devil here
You don't know what I saw before getting here
I get small bad character, leave am there
Dey try to make amends, oh my dear
No mean say na me be the devil here
You don't know what I saw before getting here
[Chorus]
Who I be na who I be oh (Ah ah)
No fit be who I no be oh (Ah ah)
If I be who I no be (Ah ah)
I no go be who I be (Ah ah)
Who you be na who you be oh (Ah ah)
You no need be who you no be oh (Ah ah)
If you be who you no be (Ah ah)
You no go be who you be (Ah ah)
[Verse 2]
Oga Network, all the lines dey connect (Yes)
Who I be any time wey e set, na the same as who I be when the rest dey collect (Yes)
I dey reach, dem dey move, dem dey stretch (Yes)
I leave the bones for the dogs wey dey fetch (Yes)
I like the meat of veins wey no dey vex (Yes)
Who you be na who you be, no dey stress (Yes)
Nobody wey work near fire, wey no dey sweat (Fact)
Nobody wey touch water, wey no dey wet
Moon no dey drag with the sun wey dey set
Shebi human being na human being?
Nobody be super being
Not even in Aso rock
Kai, know what I mean? (Yes)
Know what I mean? (Mhmm)
Know what I mean?
Sometimes na rice, sometimes, I do amala things
Sometimes smally, sometimes, I do Babara things
Sometimes I do babara things
[Chorus]
Who I be na who I be oh (Ah ah)
No fit be who I no be oh (Ah ah)
If I be who I no be (Ah ah)
I no go be who I be (Ah ah)
Who you be na who you be oh (Ah ah)
You no need be who you no be oh (Ah ah)
If you be who you no be (Ah ah)
You no go be who you be (Ah ah)
[Verse 3]
If you are taller than me
You no fit short pass me
If you are faster than me
You no fit slow pass me
E get where you for dey
E get where me myself dey
Everybody get where they for dey, ahh ahh
[Outro]
Ogogoro no dey block for fridge, na who e be oh
Man go give belle, woman go carry am, na so e be
Written by: Evans Ifeanyibema