Top Songs By Graham D
Similar Songs
Lyrics
[Intro]
Graham D na my name oh
It's Graham D, Baba
Eh oh, eh oh
[Chorus]
Papa oh, Almighty God
You sure say we go make heaven oh, oh-oh?
Papa oh, Almighty God
You sure say we go make heaven oh?
But make e mara mma
Make everywhere mara mma
Make e mara mma
I want to make heaven and make money
Make e mara mma
Make everywhere mara mma
Lord make e mara mma weh weh, uh uh
[Verse 1]
Papa, na when oh?
When You go make everywhere stew?
Na when oh?
Papa, na when oh oh oh?
We don already get rice, where the stew? (Question)
These days everywhere e casted (Casted)
Everywhere e casted (Casted)
Nothing dey last oh
Some pastors now dey do juju
Dem dey do make people for full their church
E get one pastor, e kill people
Bury for front of church, make members for full him church
This life, nobody righteous
We all na sinners
We don't give a F anymore
E get one woman, she dey sell food oh
People no dey gree come her shop
Na so she come dey wash put
Every mensuration for month end, she dey wash put
For food wey people dey put for belle oh, why oh why?
What a wicked world (Oh God)
[Chorus]
Papa oh, Almighty God
You sure say we go make heaven oh, oh-oh?
Papa oh, Almighty God
You sure say we go make heaven oh?
But make e mara mma
Make everywhere mara mma
Make e mara mma
I want to make heaven and make money
Make e mara mma
Make everywhere mara mma
Lord make e mara mma weh weh
[Verse 2]
Lord, no let them spray me money and take away my destiny (Chukwu biko)
No let them dash me physical and take away the spiritual
Cos this life now, I no trust anybody
Cos this life now, I no trust a single person, yeah eh, uh huh huh
Ndị a mụrụ ụsọ fọnọ
I no dey look Uche face, I no even know Uche (Who dem dey call Uche?)
You say you dey do yahoo, no be ordinary yahoo, person blood e follow too (You are a killer)
Why oh why?
Why you no fit do clean, you go use person head? (Question)
Why oh why?
Carry kala take am rob another person sweat (Oh God)
Papa oh, Almighty God, I no sure say we go make heaven oh oh-oh
99 percent of our girls na runs girls
Na runs girls, na runs girls
Dem dey share their kpekus, distributing kpekus
Person seriousy go dey do another person husband for money
So, you sure say we go make heaven ooh ooh ooh?
Papa, Almighty God, I no sure say we go make heaven oh, uhh uhh
[Outro]
Me sef dey find money
Me sef go make heaven
Wicked mix
Eh eh eh
Uh uh uh uh, yeah yeah
Imagine say the world e end today nah
Hell fire direct
Oh oh-oh
Papa oh, Papa oh uh
It's Graham D, Baba
It's Graham D D D D
Thank you Jesus
Written by: