Letras
Yeah! Straight from the creek of South South
Was gone for a sec but now I’m back
No be your Ac spoil I’m hot
Who goes there disembark
The country hard I no lie
To make am for Lag na die
Why you think say dat banny do nyash
Even some Lekki boys dey do naysh
Many graduate no get work o
Some no dey see anything chop o
Una road dey make body dey pain me
To dress comot hard as police fit go detain me
But when we talk she say we dey on drugs
Call us children na you dey pay we sub
People dey hungry where your conscience
You hide am like palliative come here dey cap nonsense
Oya! give account you done dey faint
Beans never done Moi-Moi dey scent
Them never talk you don dey cry
Our leaders na cruise guy
Pop your molly smoke your igbo
This country get as e dey go
But on top of this some people lodge
Room 306 dey pray to God
To be man for this country hard
Why you think say bobo discharge
Before I forget go loose guard o
Make god punish Lord Luggard
Go her page write my favourite couple
When wife travel husband you fuck o
Just dey jaru the man dey drop
Pass Uber cab the man dey drop
People dey loot dem dey shoot us
Ontop the kind suffer dem put us
Who pay the hoodlums come with badge
This country need Ijaw massage
Ashawo say she love me die
I give my wife make she reply
She say she want bone straight
Block her for my phone straight
You no love am o her na Jaruma
Carry the money give your mama
Home and relax with your one
Say im side chick dey cheat on am
Abo na 2021
Forget this year, this one done wam
Written by: Erigga